Saturday 16 May 2015

JOKES CORNER: Your daughter, your mother or your wife?

Emeka: U be fool, u no sabi anything.
Akpos: Ahhh...haba guy
Emeka: Na so na. I fit prove am sef. If na night and u see 2 light for road, na wetin be dat?
Akpos: Na moto!
Emeka: Ehenh, but witch kind? Benz, Peugeot or Lexus?
Akpos: I no know dat one oh!
Emeka: U see am. Anyway, second proof. Na night, u see 1 light for road. Na wetin be dat?
Akpos: Na okada!
Emake: Ehenh, witch one? Suzuki, Yamaha or Kawasaki?
Akpos: Ahh....how I wan take know?
Emeka: U see am? I don show u say u be fool.
Akpos: Na wa 4 u o. Dis ur question sef. Oya make I axe u. If na night u see woman for roadside....miniskirt, big breast, red lips, big nyash,na wetin?
Emeka: Na ashawo!
Akpos: Ehenh, but which one? Ur mama, ur sister or ur daughter?


@Calabar_links

No comments:

Post a Comment